Oga for Suya Blaming IDPs For the Attack No make Sense At all; Because...
Oga for Suya Blaming IDPs No make Sense At all Because...
Our Presido finally reach Benue State, because VDM first go_ but even as e land, him no fit waka go the exact place wey that gbege (kpaing) happen. The excuse wey Presido give be say rain too much, and as him no carry umbrella come, na only broom him bring. You know say broom no dey stop rain — na only to sweep e sabi. Presido come also talk say water full everywhere, say if him no take time, e fit go kpai join for wetin him no sabi.
Na so Presido waka reach hospital, go check on people wey the attack injure. As him reach there, him just dey shout:
“Eyaaah! Sorry o! Sorry oo!! Doohhh!!”
Presido eyes come full water when him see one man wey lose all him family — na only one 9-month-old baby survive the wahala.
Our Presido come yarn say:
“If una see anything wey no clear, make una talk! Many of una for IDP camp know say some of the bad people dey hide inside camp, but una keep quiet. Why?”
But the matter wey dey pain many Nigerians be say, Presido forget say na him first tell dem Suya pipo (soldiers) make dem no touch the so-called repent Boko Haram wey say dem don Born Again, say na now dem dey follow Allah and Jesus.
Presido even organize welcome party for dem! SowAsoebi, give dem food, do thanksgiving. Instead of say make dem go do farm work for Sambisa forest, Presido give dem uniform, gvn and position, join dem back for Naija Suya (Army).
Wetin Presido been no sabi be say, no be everybody wey say “I don repent” truly change for heart.
Na so dem fake repented Boko Haram people take sabi all the military corner-corner way, come dey leak secret to real Boko Haram padi dem — for Ibibio language, cunning cunning na "Mbia" and leaking of secret na"Nsubor".
Na so over 200 innocent people just kpai like chicken.
And now, Presido and military dey blame IDPs sey them no talk. But truth be say, many people no fit talk everything wey their eyes see, for their fear of come back attack. Sometimes, na the same security people wey you report to go turn around go sell you out.
If the Suya people been really want to do their job wella , them for gathered information well enough to even fish the bad pipo out even before other pipos know, but because many bad eggs full their group, to gather such information be like say na WAEC !
And if dem really be intelligence officers, dem suppose use dem big-big oyibo technology know who be who, no be to dey blame innocent people.
We no go talk too much, because na security matter we dey yarn. But make Oga Suya (Military Chief) try remove all the bad eggs from the Army. Dem no suppose dey there at all — dem be dangerous heads.
Na only God get power pass everybody.
May He help protect the innocent
Comments
Post a Comment