Oga for Suya Blaming IDPs For the Attack No make Sense At all; Because...
.jpeg)
Oga for Suya Blaming IDPs No make Sense At all Because... Our Presido finally reach Benue State, because VDM first go_ but even as e land, him no fit waka go the exact place wey that gbege (kpaing) happen. The excuse wey Presido give be say rain too much , and as him no carry umbrella come, na only broom him bring. You know say broom no dey stop rain — na only to sweep e sabi. Presido come also talk say water full everywhere , say if him no take time, e fit go kpai join for wetin him no sabi. Na so Presido waka reach hospital , go check on people wey the attack injure. As him reach there, him just dey shout: “ Eyaaah! Sorry o! Sorry oo!! Doohhh!! ” Presido eyes come full water when him see one man wey lose all him family — na only one 9-month-old baby survive the wahala. Our Presido come yarn say: “If una see anything wey no clear, make una talk! Many of una for IDP camp know say some of the bad people dey hide inside camp, but una keep quiet. Why?” But th...